Sunday, 16 May 2010

The workers responlogues

Will you vote in 2011??

Fote...why I won't fote...2011 lagbara oloun, i we fote for d best shoize candidate...

Nna bros, if dem sho me kishi, wey dem go give me may i vote, notin way fit stop me, I go vote but if not na maket i suppos dey da day...tinkin sha, depending on d candidate's promises...if it fit blend, i fit considaram...

What do you think should be done about corruption?

Hmm, Nigeria she is too corrupt, all the big big men, too stealing...ahn ahn...anyway one day, we too we reash there,if not God almighty we judge all liars, all tifs, all corrupters stealing our money in this Nigeria...

Well, I tink tath we shud embrace democracy so we will not be corrupt again...

Corruption, is everywhere, even if look at US, Uk,Jamny,France they have corruption over there too so what can we in Nigeria do, we just hope and pray to the almighty to deliver us...

Should they ban okadas in Lagos?

Anybody that ban okada is fery wicked, yelz, there is dangerous in it but poor man wey no get car wetin in go do when traffic dey, okada is a fast way to reash somewhere you are going so they should not ban it...

Ban Okada, in dis Lagos, e no fit happen....

Would you wear a helmet on an Okada?

Ah I don't really say for nown, because you know everywhere there is juju but if Jesus is your personal Lord and safiour, no efil can arm you...

Is Fashola doing a good job in Lagos?

Ah Eko o ni baje...yez, look at the road, park, eferytin is fine, Fashola I say more greaze to your enbow...

Well, Fashola is working hard here, iz not easy but you know tings are more harder now...no shop anywhere, anyhow, man no fit chop, it dey divicut but notin sha, God dey and Fashola dey try make Lagos better so we go wait see...

Wednesday, 10 February 2010

The Hairdresser logues

Ah Madam good afternoon kile fe se si irun yin...e fe ko bance...you want bancing cois or waving cois... The hair that is very best for that is romance cors...it haf bancing cois and eev we straigt it it wee haf waving cois...

Oh you want to wash and set your ear... ok madam sat down lez remoof the braids for you...ahn ahn why ma ofcos we will not cut your ear...


Ahn eku ijoko o, se ese o dun yin, ati fe se irun yin tan...ahn sorry ma you haf no speak yoruba...i am say well sit o, we af finish your hair fery soon...

Hei Aunty Buki, e ri madam to wo ibi nisin, te ba ri irun to ko sabe wave on yen e le mo lai lai pe olowo ni won...

Ewo Aunty Taiye, laye laye ti n ba ti ni customer, e ma elp mi mo ahn ahn..

Home savice,for any type of any hair star and oda savices sush has pendicure and manyicur...contact Lady PM for foda deetayls...

Mary, d guy wey we see yesternight don dey call dey axe for you o, i tell am say na haidrezza you be no be ashawo say if e won gelfriend im sopose pay the price first...im con talk sey afta closing from shop today,make we go chop in Mr Biggs, na im a talk sey Got forbit, us we dey work, mr Biggs...i reject...i upgrade us straight, we dey go tantalisers and im say may we no take bus, im go pay for teizi and im go drop us at home...and on saturday im go take us shopping for yaba...see i don tell am from start,you no be ashawo wey im go just use pay, im go first pay before...