Wednesday, 13 May 2009

The Driver Monologues

Glory Glory, fine geh! So wa pa? Omo to dun!omo to sesy...ow you dey noun! I don co your gee-es-em many ha times buh you af no pick. I don mizz you gan o...your buttocks no dey roll commot in front of my highs again. So fictoria highland nain you dey noun...ahn ahn eyin len gbadun. I ear say da saeed na so so jeep jeep foo dere. Na tru dem tok...
Oga don efen buy nue car sef, masdis benz g wagon...i nefa drife am yet buh a tink say oga dey trafu go abrod so i go dey carry di car comot go wash am and evfytin...i fo come feehii dat kain time o!!!!!ah why i no tink am sinz...ok make we arrange tain wey we go see...a baby yi ani mo to mizz e gan...glory glory oloyon milk...oti dun ju...you are too sweet...mwah..walahi i fo marry you! Ahn ahn too sweet a girl...

No comments:

Post a Comment