Wednesday, 13 May 2009

The Househelp Monologues

Oga Felix,

How far na blessing?how you dey?shey body dey kampe?in dey for clot?we tenk baba God.
I bin for co or test sinz wey I leaf madam place comot but i no ket craydit...I don moofe go feegsee dey work wit one madam wey dey sell clot for arand that eekecha saeed...the madam nize past oga madam for ikoyi. i don even stat to dey go sku for arand our area... anyway I jus say make i sheck on you make we relate...i nefa fourket you o....oga felix...this na my number wey i use test you 08032245689,make you safe am,call me or test me ehn...
olright we go yan...
creet efrywan for me, mummy glory, amaka, oga gardener, baba gateman and chief sayquereeti.make you hep me creet Oludara and Ayokunmi...i don miss dem sha...dose shidren...ah...

2 comments:

  1. Ok you need to read! ah ahn! all this random things..lol! funny! o and yea you like xmen origins wolverine? thats intresting!!! I like crash too:)

    ReplyDelete
  2. Haha, I do need to read!!!!!!!thank you!!!!!
    I do like x-men!it has political meaning!!OMG,next blog topic...thanks for the inspiration!!!

    ReplyDelete