Washman: Barebay, you know wetin I want na...Omalichanwa...preeddy girl...When a clos my eyes na so so youare face nain a dey see...na trut..your love don drive me maad...ah my head dey scatta...nne make you tok sontin wey go maek me happy noun...
Househelp: heh, Cheezes, Chineke meh, washman you dey crase...How you fo see apple, for tree as short as you be so, you wan climb tree pick am...biko look for youare level...me Nneka like this, look at you, common washman when the carpenter, Ugo wey get shop nest street dey follo me around like dog...na washman I go follo...chei, God forbid...may it not be my portion in Cheezes name...
Washman: Chineke, you call me a whole entaprenor,common washman, i am a drycleaner, i run a laundromat...i be wan beta youare life ni...ahn ahn, see this girl o...a whole Chidi...ndiigbo wan of Arochu...
Househelp: Abeg shotop for deir, anofia, onyiara, you wan beta my life...na your mama,your sister,your aunty life go need washman bettaram...you dey crase...common getat of here, go wosh clot when dem give you,osiso...
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment